Saturday, 4 May 2019
YARD PALAVA
My people my people una well done o jare.
Hmmmm nawa for wetin dey happen for this we yard o.
Today episode on yard palava na about this my co tenant wey don marry and at the still time him na gigolo wey no dey make make money. This my co tenant, even before him marry na so so old women wey reach to born am him dey always carry. And the worst part be say we no dey see the money for him body.
This bros you go hardly see am with small girl. People for our yard even surprise when him marry one young fine girl like that. Na so we come dey happy say bros gigolo go stop him escapades now wey him don marry but for where. Anything wey bros wife go her family house like this, na so bros go invite one over sharpaly. No type of old woman wey bros no dey carry o. The thing tire people wey dey our compound so tey one even come dey ask me nonsense question say how dey bros take dey enjoy this women, abi if the old women dey turn bros on?
If una see the kin eye wey i look am eh. Na so i ask am if na me and bros dey do the thing together or if i dey bros mind to take know wetin him dey feel? As the aproko master concern abi?
Nobody gree tell him wife o, because e no concern us and even she fit no believe am; so all of us na siddon dey look we dey.
Aunty troublemaker even tell me one day say she go tell the wife everything wey her husband dey do, na so me i tell her say nothing concern her and make she mind her troublemaking; na so aunty wan face me that day. I just jejely leave her enter room cos me i no fit begin shout with mad woman.
Bros gigolo wey no dey make money kontinu, i sha know say one day you eife go catch you because everyday is for the thief and one day is for the owner.
Na the aproko wey i get for una today be that.
Make una enjoy una weekend
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment