Nobody among all of us know say na wetin this lady get for mind not even aunty troublemaker. As the lady do like say she wan go enter her room na so she stand up dey waka dey go and as God wan take punish aunty troublemaker, she dey the side wey the lady room dey. Na so this lady grab aunty o come begin beat am oo. She beat nonsense and ingredients for aunty body o.
The way wey the film take happen sef funny me; i no know when i burst laugh. Before people try to separate them aunty don chop beating wella. As aunty see small space free herself from the lady hand na so she run enter her house come lock her net, come continue to dey curse this lady oo.
The lady just leave her enter her room because she don give her enough beating as she like. Aunty no stop to curse this lady o even after everybody don leave her enter their room. Me i no know say aunty see me dey laugh her as she dey chop beating o, i just notice say aunty stop to dey great me and me i no care. Na one of my neighbour na im tell me the reason why because aunty tell am.
Wetin concern me abi na, who her greeting epp? Shebi she dey feel say she like trouble now she don jam who pass her.
Oshisko mtcheeeeeew.
No comments:
Post a Comment