Today on yard palava.
There is this neighbour of mine that can quarrel for Africa. If possible quarrel with a spirit.
Aunty can quarrel so tee people go tire to tell her o ti to( e don do) but aunty no dey hear e don do oo. Infact na that time wey you dey tell her e don do na him she dey shout pass. People for yard go tire to tell her say e don do and everybody go enter their room go sleep so that she go kontinue to shout her shout well.
This aunty continue this madness until one day she jam who pass am.
Another of my neighbour(a guy) bring him woman to come dey stay with am, na so this aunty clinch to the lady them come become friends o.
Me just the look the lady with one eye. For my mind i talk say e ma ro onye gi ni a ne me oyi( you no know who you and am be friend). Wetin con sain me, na sedon look i dey for this compound oo.
Na so one day i dey inside my room jejely dey listen to music, na im i begin hear this aunty voice o. For my mind i say she and who again today. I shock when i come out e come be she and her new best friend oo.
When we ask wetin cause problem she say aunty tell the lady bad things about her guy and since then the lady begin avoid aunty o, na so aunty vex con dey talk to her anyhow.
This lady just dey look aunty as aunty dey curse her. Wey dey tell aunty say e don do but as usual aunty no hear oo.
Na so this lady stand up like say she wan enter her room o, na that time casala burst o.
WATCH OUT FOR PART 2
No comments:
Post a Comment